english
stringlengths 19
466
| pidgin
stringlengths 7
510
|
---|---|
Then I set before the sons of the house of the Rechabites bowls full of wine, and cups; and I said to them, “Drink wine.” | Den I put cup and basin wey wine full for Rekab pipol front kon tell dem, “Make una take wine drink.” |
But You have severely broken us in the place of jackals, And covered us with the shadow of death. | Yu don skata us for groun like dirty wey dog dey run pass; Yu don kover us with darkness. |
So she gleaned in the field until evening, and beat out what she had gleaned, and it was about an ephah of barley. | So Rut kon gada rice for di farm till evening. So, wen Rut look all wetin e gada, e heavy rish three pounds! |
The righteous also shall see and fear, And shall laugh at him, saying, | Doz wey dey do wetin dey rite, go si am kon happy. Dem go laf dey sey, |
Then God said, “Let Us make man in Our image, according to Our likeness; let them have dominion over the fish of the sea, over the birds of the air, and over the cattle, over all the earth and over every creeping thing that creeps on the earth.” | Den God sey, “Make wi kreate human being like Awasef, just as wi bi, so dat dem go bi oga ova di fish dem for sea and di birds for di sky, plus di kattles and ova di whole eart plus evritin wey dey inside.” |
Open the gates, That the righteous nation which keeps the truth may enter in. | Make una open di town gates, so dat di nashon wey dey faithful; wey en pipol dey do wetin dey rite, go fit enter. |
O you daughter dwelling in Egypt, Prepare yourself to go into captivity! For Noph shall be waste and desolate, without inhabitant. | Egypt pipol, make una ready to go Babilon as slaves! Dem go turn Memfis to desert and e go bi dirty land where nobody dey stay. |
For the children of Joseph were two tribes: Manasseh and Ephraim. And they gave no part to the Levites in the land, except cities to dwell in, with their common-lands for their livestock and their property. | Dem si Josef shidren as two tribe, Manasseh and Efraim. Dem nor give Levi pipol any land; aldo dem give dem towns where dem go stay, plus fields where dia animals go for dey chop. |
Thus says the Lord of hosts: “Consider your ways! | “God wey get pawa sey, ‘Make una tink about wetin dey happen to una naw.’ |
But, as he who was born according to the flesh then persecuted him who was born according to the Spirit, even so it is now. | For dat time, di one wey dem born for normal way, trobol di one wey dem born with di Spirit and na so e bi with una naw. |
Let Him take His rod away from me, And do not let dread of Him terrify me. | Who go fit stop god make E nor ponish mi again, so dat e nor go make mi fear again. |
imploring us with much urgency that we would receive the gift and the fellowship of the ministering to the saints. | and dem dey beg us make wi let dem do am, so dat dem go get di blessing wey dey follow pipol wey dey give. |
The Levites took down the ark of the Lord and the chest that was with it, in which were the articles of gold, and put them on the large stone. Then the men of Beth Shemesh offered burnt offerings and made sacrifices the same day to the Lord . | Doz wey kom from Levi tribe, karry di Kovenant Box with di cupboard wey get di gold tins wey follow di box kon go put am near di big stone. So Bet-Shemesh pipol offa burnt ofrin and sakrifice to God. |
“Aaron and his sons shall assign all the service of the sons of the Gershonites, all their tasks and all their service. And you shall appoint to them all their tasks as their duty. | Moses and Aaron go make sure sey Gershon pipol do all di work and karry evritin wey Aaron and en sons suppose use. |
‘Cursed is the one who moves his neighbor’s landmark.’ “And all the people shall say, ‘Amen!’ | Anybody wey tif en neighbour propaty or kut en neighbour land join e own, na curse go follow am. Den all di pipol go ansa, “Amen.” |
And saw among the simple, I perceived among the youths, A young man devoid of understanding, | and I si many men wey nor get sense, but I notis one among dem wey foolish well-well. |
Because you have pushed with side and shoulder, butted all the weak ones with your horns, and scattered them abroad, | Yes! Una push di ones wey dey sick kon drive dem komot from where di oda sheep der. |
and that He might make known the riches of His glory on the vessels of mercy, which He had prepared beforehand for glory, | E dey do like dis to show en glory wen E pity for pipol wey E choose to show en glory. |
For the nation and kingdom which will not serve you shall perish, And those nations shall be utterly ruined. | But dem go distroy any nashon wey nor gri serve una. |
Yet at the scent of water it will bud And bring forth branches like a plant. | wen wota tosh am, e go grow like seed wey dem just plant. |
It shall be as the hunted gazelle, And as a sheep that no man takes up; Every man will turn to his own people, And everyone will flee to his own land. | Di strenjas for Babilon go run go dia own land and dem go skata like animals wey dey eskape from hunta or like sheep wey nor get who dey look dem. |
And they shall come from the cities of Judah and from the places around Jerusalem, from the land of Benjamin and from the lowland, from the mountains and from the South, bringing burnt offerings and sacrifices, grain offerings and incense, bringing sacrifices of praise to the house of the Lord . | Den pipol go kom from Judah town and from all di village wey dey round Jerusalem; from Benjamin town go rish di hill, mountins and from sout for Judah. Dem go bring burnt ofrin, sakrifice, korn ofrin, incense and tanksgivin ofrin kom my temple. |
And just then, while she was still talking with the king, Nathan the prophet also came in. | As Solomon mama still dey tok to di king, Natan kon kom di house. |
So I said in my heart, “As it happens to the fool, It also happens to me, And why was I then more wise?” Then I said in my heart, “This also is vanity.” | So I tell mysef, “Na wetin go happen to fools, go still happen to mi! Both of us go still die! So wetin I kon gain with all dis wisdom wey I get?” So I kry kon tell mysef, “E nor get any good tin wey wisdom dey give!” |
Do not enter into judgment with Your servant, For in Your sight no one living is righteous. | Make Yu nor judge mi yor savant, bikos evribody dey guilty for yor front. |
And the Lord said, “My Spirit shall not strive with man forever, for he is indeed flesh; yet his days shall be one hundred and twenty years.” | So Oga God kon sey, “My Spirit nor go fit stay with man again pass one hundred and twenty years, bikos dem bi ordinary human being.” |
He said to Him, “Which ones?” Jesus said, “ ‘You shall not murder,’ ‘You shall not commit adultery,’ ‘You shall not steal,’ ‘You shall not bear false witness,’ | Di man kon ask, “Wish one for di kommandment?” Jesus ansa, “Make yu nor kill, nor sleep with pesin wey nor bi yor wife, nor tif, nor tok wetin yor eye nor si, |
The sons of Bela were Ezbon, Uzzi, Uzziel, Jerimoth, and Iri—five in all. They were heads of their fathers’ houses, and they were listed by their genealogies, twenty-two thousand and thirty-four mighty men of valor. | Bela kon born five sons: Ezbon, Uzzi, Uzziel, Jerimot and Iri. |
Then both Mahlon and Chilion also died; so the woman survived her two sons and her husband. | Den Naomi two sons, Mahlon and Kilion kon die too. So Naomi nor get husband or shidren again. |
You will go out through broken walls, Each one straight ahead of her, And you will be cast into Harmon,” Says the Lord . | Dem go drag una kom out from di small hole wey dey una wall kon karry una go Harmon land.” Na so Oga God tok. |
Have I sinned? What have I done to You, O watcher of men? Why have You set me as Your target, So that I am a burden to myself? | Yu wey dey wosh us, na wetin I do Yu? Abi I don sin against Yu? Why Yu dey target mi? I bi wahala to Yu? |
Then you shall put the two braided chains of gold in the two rings which are on the ends of the breastplate; | Yu go tie di two gold shain join di two rings for di end for di chest side, |
The rivers will turn foul; The brooks of defense will be emptied and dried up; The reeds and rushes will wither. | Di place where di river dey flow from go dey smell and all di rivers go dry. |
You have commanded us To keep Your precepts diligently. | God sey make wi obey and keep yor kommand well-well. |
So the Philistines fought, and Israel was defeated, and every man fled to his tent. There was a very great slaughter, and there fell of Israel thirty thousand foot soldiers. | So Filistia pipol kon fight and kill Israel pipol well-well till di remainin ones, run go house. Di pipol wey dem kill many well-well; 3,000 sojas wey dey waka for groun die for di war; |
“Take this Book of the Law, and put it beside the ark of the covenant of the Lord your God, that it may be there as a witness against you; | “Make una take di Law Book kon put am near di Oga una God Kovenant Box. E go dey der as witness against una, |
nor let Hezekiah make you trust in the Lord , saying, “The Lord will surely deliver us; this city will not be given into the hand of the king of Assyria.” ’ | Make una nor let am force una trust God. Abi una tink sey God go save una, so dat Assyria sojas nor go kapture una town? |
When they asked him to stay a longer time with them, he did not consent, | Wen dem sey make e stay with dem small, e nor gri, |
The other king was Og king of Bashan and his territory, who was of the remnant of the giants, who dwelt at Ashtaroth and at Edrei, | E win King Og for Bashan wey dey among di remainin Refah pipol and e dey stay for Ashtarot and Edrei. |
Your wrath lies heavy upon me, And You have afflicted me with all Your waves. Selah | Yor vexnashon dey press mi and yor waves don kover mi. |
He may eat the bread of his God, both the most holy and the holy; | Di pesin fit chop di food wey dey holy well-well and di holy food wey bi God own, |
And lest your heart faint, And you fear for the rumor that will be heard in the land (A rumor will come one year, And after that, in another year A rumor will come, And violence in the land, Ruler against ruler), | Make una nor fear or luz hope, bikos of wetin una hear. Dem go dey tok difren tins evry year about fight for di land and dem go sey one king dey fight anoda one. |
“Look, I go forward, but He is not there, And backward, but I cannot perceive Him; | I don find am go east, but I nor si am. I nor si am for west wen I find am go der too. |
And they baked unleavened cakes of the dough which they had brought out of Egypt; for it was not leavened, because they were driven out of Egypt and could not wait, nor had they prepared provisions for themselves. | Dem bake bread wey nor get yist with di bakin pan wey dem dey karry komot Egypt. Di bread nor get yist, bikos dem hurry dem komot from Egypt, so dem nor get time to prepare food for demsef. |
“Behold, it is written before Me: I will not keep silence, but will repay— Even repay into their bosom— | I don already know how I go take ponish dem and dem don rite di way dem go take die for groun. I nor go look wetin dem don do kon trowey face, but I go pay dem back |
“But cursed be the deceiver Who has in his flock a male, And takes a vow, But sacrifices to the Lord what is blemished— For I am a great King,” Says the Lord of hosts, “And My name is to be feared among the nations. | Curse dey di pesin head wey dey play wayo and offa yuzles animal, wen e bi sey e get many betta animals wey e promise sey e go give mi! I bi strong king and all di nashon dey fear mi.” |
the border shall go down along the Jordan, and it shall end at the Salt Sea. This shall be your land with its surrounding boundaries.’ ” | Den e go-go Jordan River go rish di Salt Sea.’ Dis go bi di four borda for una land.” |
And he broke in pieces the sacred pillars and cut down the wooden images, and filled their places with the bones of men. | E skata dia juju pila finish kon kut Asherah juju pole rish groun, den e pak human being bones full di shrine. |
They pant after the dust of the earth which is on the head of the poor, And pervert the way of the humble. A man and his father go in to the same girl, To defile My holy name. | Dem dey mash poor pipol head for san-san kon push doz wey nor get who go help dem komot for road. Papa and pikin dey sleep with di same woman and like dis, dem don spoil my name wey dey holy. |
Then he said, “I saw all Israel scattered on the mountains, as sheep that have no shepherd. And the Lord said, ‘These have no master. Let each return to his house in peace.’ ” | Mikaya ansa, “I si Israel soja wey skata for evriwhere for di hill like sheep wey nor get who dey kare for dem. And God sey, ‘Dis men nor get leader, make dem go house with peace.’ ” |
And Isaac went out to meditate in the field in the evening; and he lifted his eyes and looked, and there, the camels were coming. | As evening dey rish, Isaak kon go di field go relax. Den e look kon si sey some kamel dey kom. |
Jesus said to him, “Go your way; your son lives.” So the man believed the word that Jesus spoke to him, and he went his way. | Jesus kon tell am, “Make yu go house, yor pikin nor go die.” Di man bilive wetin Jesus tell am, so e kon komot go en house. |
then Zedekiah the king sent and took him out. The king asked him secretly in his house, and said, “Is there any word from the Lord ?” And Jeremiah said, “There is.” Then he said, “You shall be delivered into the hand of the king of Babylon!” | Afta, King Zedekaya sey make dem koll mi kom, den e take mi go korna kon ask, “God give yu any message for us?” I ansa, “Yes! E give mi.” Den I sey, “Babilon king go kom katch and karry yu go.” |
But I am poor and needy; Yet the Lord thinks upon me. You are my help and my deliverer; Do not delay, O my God. | I dey poor and I nor get anytin, so make God keep mi for en mind. My God, make Yu kwik kom, bikos na Yu bi my help and di Pesin wey go save mi. |
that the Lord appeared to Solomon the second time, as He had appeared to him at Gibeon. | God appear to am again, just as E do for Gibeon. |
And we are His witnesses to these things, and so also is the Holy Spirit whom God has given to those who obey Him.” | All of us know sey dis tin na true and di Holy Spirit wey God don give to pipol wey dey obey am, dey still bear witness sey, dis tin na true.” |
But, O Lord of hosts, You who test the righteous, And see the mind and heart, Let me see Your vengeance on them; For I have pleaded my cause before You. | My God wey dey mighty; Yu dey give korrect judgement to pipol and Yu know wetin dey dia heart and mind. So, make I si how Yu won take revensh my enemies, bikos I don put my problem for yor hand. |
Now the Passover, a feast of the Jews, was near. | (Dat time, Passova Feast don rish.) |
Stir up Yourself, and awake to my vindication, To my cause, my God and my Lord. | Make Yu raiz-up kom defend mi! My Oga God, make Yu take my matter like yor own. |
When Abram was ninety-nine years old, the Lord appeared to Abram and said to him, “I am Almighty God; walk before Me and be blameless. | Wen Abram na ninty-nine years, God appear to am kon sey, “Na mi bi di Oga God wey get pawa. Follow mi waka and nor-tin go do yu. |
For yet a very little while and the indignation will cease, as will My anger in their destruction.” | E remain small for mi to ponish una finish, den I go distroy dem for una. |
According to the lot their inheritance shall be divided between the larger and the smaller.” | Dem go get dia share with di dice akordin to di group wey small or big pass.” |
Now the rest of the acts of Baasha, what he did, and his might, are they not written in the book of the chronicles of the kings of Israel? | Evry oda tin wey Baasha do, dem rite am for Israel kings history book. |
Therefore God also gave them up to uncleanness, in the lusts of their hearts, to dishonor their bodies among themselves, | So God don leave wiked pipol make dem dey do di bad tins wey dia mind, wey bi sey man dey sleep with man and woman dey sleep with woman. |
They were a wall to us both by night and day, all the time we were with them keeping the sheep. | Both for nite and day time, dem dey guide us wen wi dey guide awa sheep. |
Now therefore, I have come to speak of this thing to my lord the king because the people have made me afraid. And your maidservant said, ‘I will now speak to the king; it may be that the king will perform the request of his maidservant. | “Naw! My king, di tin wey make mi kom tok to yu bi sey di pipol dey treaten mi, so I tell mysef sey I go tok to yu and yu go do wetin I ask. |
Solomon begot Rehoboam, Rehoboam begot Abijah, and Abijah begot Asa. | Solomon born Rehoboam, Rehoboam naim bi Abijah papa and Abijah kon born Asa, |
Also your people shall all be righteous; They shall inherit the land forever, The branch of My planting, The work of My hands, That I may be glorified. | Una pipol go do di rite tin and dem go get di land forever. Na mi plant and make una, so dat evribody go know how I great rish. |
if indeed you continue in the faith, grounded and steadfast, and are not moved away from the hope of the gospel which you heard, which was preached to every creature under heaven, of which I, Paul, became a minister. | If true-true una get faith and una leg strong for groun, den una go get hope kon whole di gospel wey una hear. Dem don prish dis gospel give evribody for di world and mi Paul don bi di gospel savant. |
“Woe to him who covets evil gain for his house, That he may set his nest on high, That he may be delivered from the power of disaster! | So e betta make una die, dan to dey build big-big house with money wey una tif. Una do like dis, so dat una go fit run from wahala and trobol. |
Jeiel the father of Gibeon, whose wife’s name was Maacah, dwelt at Gibeon. | Jeiel (wey bi Gibeon papa) dey stay for Gibeon town. En wife name na Maaka. |
And Joseph said to his brethren, “I am dying; but God will surely visit you, and bring you out of this land to the land of which He swore to Abraham, to Isaac, and to Jacob.” | Den Josef tell en brodas, “Na die I dey so. But God go true-true kom meet and take una go di land wey E promise sey E go give Abraham, Isaak and Jakob.” |
The earth, O Lord , is full of Your mercy; Teach me Your statutes. | My God, yor love wey nor dey fail, full di world; so make Yu tish us yor laws! |
And He went through the cities and villages, teaching, and journeying toward Jerusalem. | Jesus travel pass some town and village kon dey tish as e dey go Jerusalem. |
Vows made to You are binding upon me, O God; I will render praises to You, | My God, I go do wetin I vow to give Yu and tank Yu, bikos of how Yu dey help mi. |
I sleep, but my heart is awake; It is the voice of my beloved! He knocks, saying, “Open for me, my sister, my love, My dove, my perfect one; For my head is covered with dew, My locks with the drops of the night.” | I dey sleep, my heart dey dream; bikos I hear my love dey nok and sey: “Open for mi, my treasure and darlin; my dove and di rite pesin for mi, bikos dew don wet my head and dust don make my hair dirty.” |
“Son of man, you dwell in the midst of a rebellious house, which has eyes to see but does not see, and ears to hear but does not hear; for they are a rebellious house. | “Man pikin, na where sturbon pipol der yu dey stay. Dem get eye, but dem nor dey si; dem get ear, but dem nor der hear, bikos dem sturbon well-well. |
And the Pharisees said to Him, “Look, why do they do what is not lawful on the Sabbath?” | So di Farisee pipol tell am, “Si, why yor disciples dey break awa law for Sabat Day?” |
Maharai the Netophathite, Heled the son of Baanah the Netophathite, | Maharai wey kom from Netofat; Baanah pikin, Heled wey kom from Netofat; |
With whomever of your servants it is found, let him die, and we also will be my lord’s slaves.” | If any of us tif am, e go die and di remainin of us go bi awa oga savant!” |
Then Bildad the Shuhite answered and said: | Bildad wey kom from shuh kon sey: |
But beware of men, for they will deliver you up to councils and scourge you in their synagogues. | “Make una dey ready, bikos pipol go arrest una karry go kourt and flog una for dia sinagog. |
For the Lord is good; His mercy is everlasting, And His truth endures to all generations. | Bikos God dey good, en love wey nor dey fail dey forever and E dey good from one generashon go rish anoda. |
to cast out all your enemies from before you, as the Lord has spoken. | Just as God sey make una do, all di enemies wey dey stay der, una go porshu dem komot. |
For if we would judge ourselves, we would not be judged. | But if wi judge awasef, God nor go ponish us. |
‘And the priest shall take the boiled shoulder of the ram, one unleavened cake from the basket, and one unleavened wafer, and put them upon the hands of the Nazirite after he has shaved his consecrated hair, | “ ‘Den, wen dem don boil di ram shoulder, di priest go take am kon put am for di Nazirite hand with one kake and one biscuit from di basket. |
“Do not consider your maidservant a wicked woman, for out of the abundance of my complaint and grief I have spoken until now.” | Nor tink sey yor savant dey wiked, bikos I just dey pray since bikos my heart dey heavy.” |
But you have departed from the way; You have caused many to stumble at the law. You have corrupted the covenant of Levi,” Says the Lord of hosts. | But una wey bi priest don turn komot from di korrect road. Wetin una dey tish naw, don make many pipol dey sin. Una don break di kovenant wey I make with una. |
By these letters the king permitted the Jews who were in every city to gather together and protect their lives—to destroy, kill, and annihilate all the forces of any people or province that would assault them, both little children and women, and to plunder their possessions, | Di king give Jew pipol for di town, di pawa to gada and protet demsef, so dat dem nor go fit distroy and kill dem. Dem fit fight anybody wey won kon attack dem kon pak dia propaty. |
As silver is melted in the midst of a furnace, so shall you be melted in its midst; then you shall know that I, the Lord , have poured out My fury on you.’ ” | Just as silva dey melt for fire, na so too dem go melt for Jerusalem, den dem go know and feel my vexnashon.” |
And the priest shall put her under oath, and say to the woman, “If no man has lain with you, and if you have not gone astray to uncleanness while under your husband’s authority, be free from this bitter water that brings a curse. | Den di priest go make di woman swear sey: “If I nor really sleep with who nor bi my husband, di curse wey di wota dey bring, nor go do mi anytin. |
So Jehoiakim rested with his fathers. Then Jehoiachin his son reigned in his place. | E die and en pikin, Jehoiashin kon take-ova as king. |
They made war with the Hagrites, Jetur, Naphish, and Nodab. | Dem go fight Hagrit, Jetur, Nafish and Nodab pipol. |
There is a river whose streams shall make glad the city of God, The holy place of the tabernacle of the Most High. | Di wota from di river dey bring joy kom God town; di special and holy place where di Holy One dey stay. |
Zebulun is a people who jeopardized their lives to the point of death, Naphtali also, on the heights of the battlefield. | But Zebulun and Naftali pipol risk dia life kon go fight war. |
Therefore say, ‘Thus says the Lord God : “Although I have cast them far off among the Gentiles, and although I have scattered them among the countries, yet I shall be a little sanctuary for them in the countries where they have gone.” ’ | “Naw, make yu tell doz wey dey with yu wetin I dey tok so. Na mi send dem go stay for strenj land kon skata dem for evriwhere. Yes, I go still dey with dem for di land wey dem dey. |
But we know that the judgment of God is according to truth against those who practice such things. | Wi know sey God nor dey lie wen E dey judge pipol wey dey do bad tins. |
For it shall be, on the day you go out and cross the Brook Kidron, know for certain you shall surely die; your blood shall be on your own head.” | If yu ever pass Kidron Valley, yu go die and di blame go dey yor own head.” |
As snow in summer and rain in harvest, So honor is not fitting for a fool. | Just as pipol nor dey espect rain for dry sizin, na so too, respet nor good for foolish pesin. |
then you shall say to them, ‘Because your fathers have forsaken Me,’ says the Lord ; ‘they have walked after other gods and have served them and worshiped them, and have forsaken Me and not kept My law. | Den make yu tell dem, ‘God sey, “Na bikos una grand-grand papa rijet mi kon go woship oda gods. Dem forget mi and nor gri obey my law. |